Sunday 20 September 2015

Pidgin proverbs

Pidgin Proverbs
1. Na for old age ashawo dey know
the value of pikin.
2. Woman wey never see problem...
Na im dey still hold
breast run.
3. Woman wey dey find pikin no dey
wear pant sleep.
4. Rat wey follow lizard enter rain, Na
later é go hear am.
5. Na for afternoon dem dey find
black goat.
6. Weather hot!! É No mean say fowl
go lay boiled egg.
7. EYE WEY DEY CRY DEY SEE ROAD.
8. Pikin wey him mama back cross
water, wey say him
march fish, wetin him mama go march?
9. Small pikin wey dem carry for back
no know say the
journey far.
10. Person wey don faint before no be
stranger to death.
11. Person wey chop belle full, no
know wetin
hungry man dey see.
12. No be as woman dey close eye
enjoy sex she dey enjoy
labour pains.
13. Yansh no get teeth but e dey cut
shit.
14. Lizard wey fall from tall iroko tree,
if nobody hail am!! é
go hail himself
15. Toto water small, but é reach prick take baff.
16. IF GIRL TAKE HUSBAND DO
BOYFRIEND, SHE GO TAKE
BOYFRIEND DO HUSBAND.
17. Cockroach wey jam fowl, jam bad
luck.
18. Na cricket tell him children say,
No matter how ground
strong, Them no go sleep outside.
19. Pikin wey say him mama no fine
they use style call him
papa blind man.
20. No be eye wey dem take chop eba
dem take dey share
meat.
21. Person wey use Elephant set trap,
na him know wetin he
wan Catch.
22. When Breeze Blow Fowl Yash Go
Open.
23. STUDENT WEY READ NA HIM
SERIOUS, BUT STUDENT
WEY
PASS NA HIM KNOW BOOK.
24. Dem no dey tell tortoise say race
don start.
25. Dem no dey tell blind man say
salt no dey for food.
26. Before you see monkey, monkey don see you.
27. Thief wey jump fence enter house
where owner dey wait
for am, no go jump again.
28. If pikin say he sabi die, him papa
sef go tell am say him sabi bury.
29. Na wetin dey sweet for goat
mouth, Na im dey kill am.
30. If e be like say everybody dey
craze" na you dey craze.
31. Meat wey you dey forbid, no use your teeth cut
am.
32. My thing and our thing no be the
same oh.
33. Na happiness dey make prick
stan

No comments: