Saturday 24 June 2017

Wahala Dey O



In a WAEC English Language Examination, Emeka was asked to complete the following statements & this was how he did:
1. He who fights and run away?
Emeka: E don surrender be dat, nah fear catch am.

2. A rolling stone?
Emeka: E no fit just dey roll, nah person push am.

3. He who lives in a glass house?
Emeka: Nah rich politician e go be.

4. A stitch in time?
Emeka: E go prevent further tear tear.

5. Birds of the same feather?
Emeka: Nah the same mama born them.

6. One good turn?
Emeka: Nah correct power steering fit do am.

7. A bird in hand?
Emeka: Weytin e wan be again if no be barbeque. Dem plenty for chicken republic sef.

8. Half bread is better than?
Emeka: Puff puff, buns or garri without sugar.

9. A journey of a thousand miles?
Emeka: Nah d person wahala be dat oh. Why e no enter car or aeroplane jeje?

10. He who laughs last?
Emeka: Get brain problem. Make dem check am oh, because nah beginning of madness be dat.

11. A patient dog?
Emeka: Nah beta hunger go kill am.

12. All work and no play?
Emeka: Nah bankers job be dat abeg.

13. Once beaten?
Emeka: Nah revenge go follow be dat.

14. A fool at forty?
Emeka: U never see dis country own.......Naija own start @50.