Thursday 14 November 2013

Pidgin English Proverbs

1.       Person wey no get money go say small stout dey bitter.

2.       Na when soldier slap you, you go sabi say police na your friend!

3.       Lizard wey fall from tree, if nobody hail am, e go hail imsef.

4.       Na who first buy motor, buy old model

5.       Na pikin wey nor know him mama boyfriend dey call am ‘UNCLE’

6.       Person wey no hear be careful go hear how manage

7.       No be everybody wey wear white for Oba Palace be Chief, Some na yam dem come pound

8.       Nor be who call police dey win case

9.       Person wey madman don bite before if him see mechanic he go take off


10.   Na when trees near each other Monkey dey show skill